Deportation of migrants: European Union tok why dis go increase for EU member states

Deportation of migrants: European Union tok why dis go increase for EU member states

Wia dis foto come from, Getty Images

Article informationAuthor, Laura GozziRole, BBC News

32 minutes wey don pass

European Commission President Ursula von der Leyen don tok say di European Union (EU) fit to “learn one or two tins” from one controversial Italian policy wey dey process migrants offshore for Albania.

Dis na as leaders of di 27 member states do one EU summit wey bin focus on migration.

As di union dey ready for di Brussels summit, she write to EU leaders to say EU executive go present one new proposal for legislation to increase deportations of migrants..

Early dis week, Italy begin send some migrants to one processing centre wey dey for Albania.

Na sixteen men dem transfer go Albanian port of Shengjin on Wednesday, but hours afta dem land dia, dem find out say two of dem na children and two odas get medical issues therefore dem go return dem to Italy.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Ursula Von der Leyen and Giorgia Meloni for Brussels on Wednesday

Oda EU kontris don begin consider ways to process migrants for third kontris.

On Wednesday, Netherlands goment say e dey consider one plan to send asylum seekers wey dem reject go Uganda.

By framing dis week summit around di issue of migration, e be like von der Leyen – wey dey begin her second five-year term as European Commission chief – dey respond to pressure on migration from across Europe.

For her letter to member states, von der Leyen say di return rate of irregular migrants from EU kontris currently na only about 20% – meaning majority of pipo wey dem order to leave EU member states no dey gree go.

Member states suppose all recognise di decisions wey oda EU kontris take to make sure say “migrants wey get return decision against dem for one kontri, no go fit exploit cracks for di system to avoid return for anoda place”, von der Leyen write.

Under di Italy-Albania scheme, some of di migrants wey dem rescue for di Mediterranean, dem go send dem go Albania wia dem go torchlight dia asylum claims.

Italy goment don already pay for di two processing centres, wey cost about €650m (£547m) go operate under Italian law.

Dem go give di migrants house while Italy dey consider dia asylum requests. Pregnant women, children and pipo wey dey vulnerable go dey excluded from di plan.

Political opponents of Italian Prime Minister Giorgia Meloni as well as several NGOs don criticise Italy deal wit Albania.

Riccardo Magi, one MP wit Europa party, say di Albania scheme dey “cruel, useless and expensive”, while NGO Doctors Without Borders say e dey “likely to result in more harm and violation of human rights”.

Civil rights activists gada near di migrant centre for Shengjin, Albania, wey dem write: “Di European dream end here.”

However, addressing MPs on Tuesday, Meloni argue say di plan na “a new, courageous, unprecedented path” wey “perfectly reflect di European spirit”.

Many oda EU member states go closely watch di implementation and di results of di Albania agreement, of which several of dem bin don attempt to respond to di surge by talking tough plus dia approach to migration.

Inside last few weeks alone, Germany reintroduce land border checks, di French goment say e dey look into making dia immigration law tighter and Poland announce plan to temporarily suspend right to asylum for pipo wey dey cross di border.

Poland Prime Minister Donald Tusk say di controversial move na to stop Belarus from “destabilising” Poland by allowing large numbers of migrants enta di kontri.

For France and Germany, na horrible murders make dem call for tougher action on immigration. One Syrian failed asylum seeker stab pipo to death for Solingen, while one migrant from Morocco murder one young student near Paris. For both cases, na men wey goment don give expulsion order wey dem never enforce kill dem.

Last month, 15 member states sign one proposal by Austria and di Netherlands to improve di “efficiency” of di deportations system.

Source link : http://www.bing.com/news/apiclick.aspx?ref=FexRss&aid=&tid=67113d3ec29848df946125cf8c033432&url=https%3A%2F%2Fwww.bbc.com%2Fpidgin%2Farticles%2Fcz6wz4jj98eo&c=12675432320646618047&mkt=de-de

Author :

Publish date : 2024-10-17 09:02:00

Copyright for syndicated content belongs to the linked Source.

Exit mobile version